logo
#

Latest news with #Atiku Abubakar

'Di plan na to weaken opposition' - Atiku on Tambuwal arrest by EFCC
'Di plan na to weaken opposition' - Atiku on Tambuwal arrest by EFCC

BBC News

time4 days ago

  • Politics
  • BBC News

'Di plan na to weaken opposition' - Atiku on Tambuwal arrest by EFCC

Tori don come out say former Sokoto State governor, Aminu Tambuwal dey Economic and Financial Crimes Commission detention ova di alleged cash withdrawals of 189 billion naira ($123 million). Di tori be say Tambuwal dey for EFCC custody wia e dey face questioning as dem dey investigate di money laundering allegations against am. "E dey for custody at our Abuja corporate headquarters. Di investigation still dey ongoing," according to local media Punch. E neva clear why di former govnor dey for EFCC custody as of di time of filing dis report and Dele Oyewale tok-tok pesin of di agency no respond to di calls and text message wey BBC pidgin direct to am. Former vice president of Nigeria, Atiku Abubakar allege say di detention of Tambuwal, by di EFCC na part of di agenda of Tinubu-led administration to "harass, intimidate, and weaken di opposition." Atiku tok dis inside one statement on X on Tuesday, e say dis adminstration dey use di fight against "corruption as political tool to turn opposition leaders into di ruling party." "Di only reason the @officialEFCC detain di former Governor of Sokoto State, Senator Aminu Waziri Tambuwal, @AWTambuwal na becos im be member of di opposition Coalition," di statement tok. "Na continuation of di Tinubu-led administration agenda to harrass, intimidate, and decimate di opposition." Atiku tok say anyone wey be associates wit di opposition na target for corruption allegations and as soon as di pesin turn into di political agenda of president dem don forgive dem of dia "sins". E condemn EFCC a mechanism to fight opposition into di ruling party adding say dis na di reason im "work hard during our administration to create di EFCC." Atiku tok say how dem dey use EFCC to empty opposition govnors into di party no go end soon while im call upon Nigerians and international communities make dem condemn dis political agenda. "Dat, definitely, no be how to build institutions. Dat, certainly, no be how to fight di monster of corruption. Indeed, such tendencies provide di stimulant for corruption to thrive," Atiku tok. "We don see how dem dey use EFCC to empty opposition state govnors into di ruling party, and di tea party no go end anytime soon." "While di genuine fight against corruption na matta wey require di total support of all Nigerians, civil society spaces and friends of Nigeria in di international community suppose condemn di objectification of am as political agenda." "We have in recent times witnessed the use of anti-corruption agencies in coercing political leaders into the ruling party. Our assurance to Nigerians is that we would never succumb to this anti-democratic machinations of railroading our people into a one-party dictatorship."

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store